
Massimiliano Allegri talk say make Jose Mourinho commot eye for Pogba matter
Juventus star Paul Pogba dey the centre of talku talku as Manchester United manager Jose Mourinho dey try sign am, to complete hin signing for the summer.
As Baba Special don already sign three players (Eric Bailly, Henrikh and Zlatan Ibrahimovic), na only one person remain for am to sign onto say e talk say Manchester United dey sign only four people this summer.

Paul Pogba dey the middle of Manchester United and Juventus battle
Real Madrid bin turn down the chance to sign Paul Pogba – Dem think say e go flop
The boss bin knack Wigan 2-0 for the first match wey e manage for Red Devils on Saturday. As e knack Wigan, the match sweet am self onto say hin players ginger for ball gan.
Paul Pogba Transfer Amebo: Man United wan pay Juventus €100m
Juventus boss Massimiliano Allegri don already warn Jose Mourinho, say make e commot eye for Paul Pogba matter, say Pogba no dey commot go anywhere.
Rio Ferdinand: Mourinho fit win League – Pogba gots score 40 goals if we buy am for €120m
“Anybody wey wan wakka commot from Juventus gots think well well onto say Juve na one of the top four best European clubs wey dey this world,” Na wetin Allegri yarn. “Juventus no be club wey dey release players anyhow. Pogba na Juve material, and last last, e go wan win another Scudetto and e go dey hope make e carry Champions League.”
Pingback: Man United bin no gree sign Renato Sanches onto say their eyes bin dey chook for Pogba | MAN UNITED IN PIDGIN
Boss forget pogba, e too cost. We need beta Cdm, a Roy keane, and matuidi na sabi boy! Plus e no cost like that.
Pingback: Juventus don reject the money Manchester United table for Pogba | MAN UNITED IN PIDGIN
Pingback: Juventus Director general Beppe Marotta talk say na lie, United neva drop money for Paul Pogba | MAN UNITED IN PIDGIN
Pingback: Jose Mourinh QnA: Rooney na my Capo, Zlatan na rich man, Mata fit stay | MAN UNITED IN PIDGIN
Pingback: Everytin You Gaz Know About Man Utd Transfers: Who don enter? Pogba? Fabinho? | MAN UNITED IN PIDGIN