The French international don drop another big hint say him go soon wakka enter Manchester United.
One Red Devils fan wey dem dey call Jonathan Perk bin jam Paul Pogba for Beverly Hill, Carlifornia. The boy bin dey celebrate hin 18th birthday, so e con beg Paul o, say make e sign for am.
This na wetin Jonathan yarn ontop hin instagram account:
“Heii, make una come see o. E sure me say this na the first United jersey wey Paul Pogba don sign since wey e gree come Manchester United. I just say make i thank am o, e don make my 18th birthday more special.”
O Boi, The way Pogba take sign the jersey, you go know say na done deal. Wetin consign am with Juventus again?
Pingback: Premier League Latest Transfer Amebo: Arsenal, Man United, Everton, Chelsea, City | MAN UNITED IN PIDGIN