
Jose Mourinho dey impressed with the way hin squad take dismantle Galatasaray
Manchester United knack Galatasaray 5-2 for Gothenburg, Sweden on Saturday. No be small knacking wey i see with my koro koro eyes and as e dey hot, Jose Mourinho don yarn mind ontop the match.
“E dey very important say my players don tap football again for some minutes ontop the knacking wey Borussia Dortmund give us for China. Dey bin need am,” na wetin Jose yarn.
“We no too get time to work on new plans and try out new things. With time sha, everything go gel. We get match against Leicester City.”
Zlatan Ibrahimovic: Our season badt already, but if Pogba wakka enter, e go badt gann
“If to say i no get plans for any of these players ehn, then i no go play dem…dem no go even dey my squad self. So i get plan for them,” Jose still dey yarn.

Marcus Rashford impress Jose Mourinho wella, e ball gan
“The way my players take ginger ehn, e sweet me. I even like am as we bin make mistake so we go fit work on am for training.”
“Na the same thing wey i go do again on Wednesday, i go play 22 players. The result wey we dey get no consign me. The koko na make all my players full ground.”
Players’ Report Card: Manchester United 5-2 Galatasaray
Then Jose Mourinho con yarn ontop the impact wey Zlatan Ibrahimovic show for the match.

The Goal wey Zlatan score make brain gan
“Papa Ibro don show us a tip of the iceberg o. E don show us say e go tear net yakpa this season.”
Valencia chop Emma’s man of match as Man United flog Galatasaray
The next match wey Manchester United get na against Everton on Wednesday, before dem go wakka go face Leicester City for Community Shield.
Five things wey we observe as Man United knack Galatasaray 5-2