Manchester United striker Romelu Lukaku go miss the World Cup qualifier match wey Belgium get against Bosnia-Herzegovina on Saturday.
The Belgian dey on international duty but e never train with the team onto say e get ankle wound.
Lukaku no dey fit to play on Saturday and the Belgium FA don reveal say e no dey part of the traveling squad wey dey go Sarajevo for the game.
Manchester United go dey happy say Lukaku dey miss the match, so e go fit recover before the Liverpool fixture wey go happen on October 14.
Jose Mourinho don inform the medical staff after United, to call Belgium team doctors, say make dem dey update dem (United) on matter wey consign Lukaku.
Man Utd October fixtures: How many matches the Red Devils go win?
Lukaku fit play against Cyprus, na the rumour wey we dey hear. Make we dey see sha.