Arsenal legend Robert Pires don predict say Monaco winsh player Fabinho go wakka enter Manchester United when January knack. The three seasons wey Fabinho play for Monaco, e play well so e con dey heavily linked to Old Trafford switch last summer but no move happen.
Wetin we understand na say Arsenal, United, and Man City bin dey chook eye for the Brazil midfielder matter and Pires believe say the guy go play for Premier League one day.
This na wetin Pires yarn for Bwin: “I dey reason say the move to United fit happen in January or next summer. Manchester City for sign am but dey don already get Fernandinho.”
Advertisements