We at MUIP wan wish Marcus Rashford Happy Birthday as e don turn 20 today.
Before Rashford blow, if person for tell me say academy player go play critical role in Manchester United’s season, i for doubt am as players like James Wilson, Macheda, Will Keane, etc bin struggle but na wetin happen.
Since the time wey the English international see chance for that Europa League game against Midtjylland wey e score two goals, e don transform into first team player.
We wan wish am all the best and we dey pray make e surpass Wayne Rooney in goal tally but we know say e go hard.
Advertisements