Manchester United striker Zlatan Ibrahimovic don yarn say the Red Devils fit lift th Premier League and Champions League title this season.
Presently, the Reds dey eight points behind Leaders Man City but the Swedish international believe say the title race no dey over as the season still dey long.
“I dey reason say we fit purshue City, Why e no go dey possible? We dey here because we wan win na and we gats win because we wan catch dem,” na wetin Ibrahimovic yarn.
“I dey reason say we fit win everything (Premier League and Champions League). Last year, we bin win two trophies and we dey stronger this season. I believe say we fit do am.”
Advertisements