Jose Mourinho don confirm say Zlatan Ibrahimovic, Nemanja Matic and Phil Jones dey fit for the Manchester derby, dem go run check on Marouane Fellaini tomorrow to see if e fit play.
The United boss don also confirm say Eric Bailly and Michael Carrick go miss the match against Manchester City.
“Na big match o as we dey face one of the best teams wey dey the country. Dem dey first, we dey second, no be small match,” na wetin Jose yarn.
“The way we dey this season ehn, we better pass how we dey last season. But omo dis City team self don improve.”
Mourinho ontop title race: “The title dey open. If dem no win am, we go win am.”
“For us, three points na the koko but we go wan win so we go fit pain the town red. Na special match.”
“Nobody for this life fit predict wetin go happen ontop pitch for football. As i be manager, i go do my gameplan sha but anything fit happen ontop pitch wey man no fit control.”