We don get confirm news from the official Man United account, say Sir Alex no dey intensive care again, but e still dey hospital. Now, Papa Alex na inpatient and na there e go continue hin recovery.
Hin family talk say dem dey very grateful with the kind support wey dem don receive. Dem appreciate una but dem dey beg make una no dey leak hin private matter to the world, say e go epp am recover fully.
Advertisements