We dey hear rumour say Chelsea don abandon their project to build new stadium as UK government no gree make Roman Abramovich renew hin visa. Upon say e wan invest one billion pounds, dem no give am visa.
As everything take be, the thing fit affect Chelsea’s transfer plans this summer as Abramovich no go wan release funds self.
The way things dey go, e no go surprise me if dem begin protest for Oshodi ontop the way things dey go with the Blues, as most of the boys wey dey Oshodi under bridge be Chelsea fans.
MORE: Jose Mourinho dey scout Marko Arnautovic – E go come Manchester United?
If say i be Abramovic, i for don sell the yama yama club self. How i go invest billions for person country and dem no go gimme Visa?
Advertisements