New Manchester United signing Pastor Fred don woundjure but e be like say e no serious as e still dey with the Brazilian squad. If say na big injury, dem for don advise am to withdraw from the World Cup.
While hin Brazilian teammates dey train, Fred dey hin hotel room as Doctors dey examine hin leg. Dem also perform Physiotherapy ontop am. I just dey pray make e no complicate hin wound for World Cup. If e no dey 100% fit, make dem no use am, abeg.
Advertisements