We wan talk about the five things wey we observe as Liverpool knack Manchester United 4-1 for Michigan Stadium. The person wey score for United na Andreas Pereirea. I no go even focus on the scoreline as na pre-season, the koko na the way the game take be.
The first thing wey we observe na say Ander Herrera na shit against Liverpool. I no sabi whether e leave hin brain for training pitch. The guy fall my hand, e no play shingbai. Hin midfield combo with McTominay and Andreas Pereira no just work today. I just dey pity am because if men like Pogba and Matic return, e go warm bench tire.
The second thing wey we observe na say Jose Mourinho’s tactics against Liverpool na dead. E bin start with three at the back (Bailly, Fosu Mensah and Tuanzebe), then Mitchell and Darmian con dey wing back. The defence na shambles against Liverpool. Dem even try for first half, but dey con fall apart for second half. Apart from Eric Bailly, the others no suppose dey start for us next season.

FPL
The third thing wey we observe na say the Liverpool game don expose Manchester United, say dem no dey ready at all for the new season. Maybe this defeat go ginger Ed Woodward to buy players as United na dead summer wise. Na only Diogo and Fred wey dem don buy so far.
Another thing wey we observe na say the United team no try against Liverpool. Dem no even pull together a series of five passes. E no sure me say dem create chance self. The goal wey dem score na free-kick, so dem no create any chance from open play. Na Liverpool play from start to finish.
The last thing wey we observe na say wahala dey o. This one wey some of our World Cup players no go start the season with us, and Diogo Dalot and Antonio Valencia don wound. We don enter one chance. I also hear say Chris Smalling don get minor wound. See ehn.
Una never see anything. Una go lose tire. Liverpool go trash una. 😁🤣 #YNWA