Manchester United manager Jose Mourinho don praise hin defender Eric Bailly for hin brave spirit during the Liverpool defeat.
As una sabi say Liverpool bin demolish the Red Devils 4-1, the United boss bin praise the Ivorian centre-back after the final for hin post-match conference.
“Eric Bailly don wound before the game and e no suppose dey play but when e see say Smalling dey injured, e don decide say e wan start because e no wan leave small pikins for back versus Salah and Mane,” na wetin Mourinho yarn.
“Now hin ankle don swell but him na brave boy.”
Advertisements