French forward Anthony Martial go return back to Manchester on Thursday as e don come back from Paternity leave.
Many people don dey yab the 22-year-old, say e no get home training. United bin give am permission when hin wife, Melanie Da Cruz wan give birth, but after she con born the baby, e no gree return back to United Tour.
We dey hear rumour say the Red Devils go fine am (£180,000) for hin sturborn behaviour.
Na wetin Martial write ontop hin instagram: “I wan thank una. My pikin dey fine. The mother bin no dey feel fine but she well now. See ehn, My family na my life. Man United matter fit wait jare… But now wey she don well, i dey come back to Manchester.”
Advertisements