Manchester United go face Newcastle by 5:30pm today and e sure me say Jose Mourinho job dey on the line. According the Sky Sports, United don yarn say hin job no dey at stake but i believe say if e lose for Old Trafford today, e go receive sack letter. Anyhow, we go cover live commentary ontop our official pidgin handle @Manutdinpidgin.
The players wey go miss the clash na Marcos Rojo, Jesse Lingard as dem don injure. Antonio Valencia fit miss am due to fatigue sha.
Personally, i dey predict 2-0 win for United with goals from Romelu Lukaku and Paul Pogba. Make we dey see sha.
Advertisements