My people how una dey,
Our heart just dey upside down as we dey wakka enter international break. After Turin, we bin dey happy as we dey come home, but after the Manchester derby, e be like say make we enter ground. E pain us wella because na derby game, the ones wey our fans bin dey wait for since. But City play well pass us so i gats hail dem. We gats improve ourselves so we fit knack dem when dem come Old Trafford.
As we manage beat Juve, e mean say we dey siddon well for our group and we fit qualify for knockout stages. Our group hard sha but the fact say we manage knack Juve, mean say our fate dey our hands.
Make we hug, enjoy una week.
Advertisements