The Red Devils dey prepare to face Young Boys tonight and we dey pray make dem collect three points as e fit mean qualification for the knockout stages.
United players wey go miss the game na Marcos Rojo and Victor Lindelof as dem don woundjure.
Luke Shaw wey bin dey suspended against Crystal Palace, go return tonight.
As Lindelof no dey, e mean say Bailly fit see chance to return back to the Starting Lineup.
I no sabi as Mourinho go line up hin attackers but i believe say Martial go dey. For the rest, i no sure. But Lingard and Mata fit dey bench.
For midfield, I believe say Pogba go start. As for Fred, Fellaini, Pereira and ko, na when 7:30pm reach, i go know their fate.
The form of United dey poor right now. Since their win against Juve, dem never win. I fit understand the City lose, but that Crystal Palace draw for Old Trafford na public disgrace.