
Na good performance but sad result for the Red Devils as dem draw 2-2 against Arsenal for Old Trafford. Na only United players score tonight as Arsenal no dey on the scoresheet at all. Two own goals, two goals. Na the story of the Reds so far this season.
Anyway, we wan rate the United players ontop how dem take perform tonight:
De Gea: I go blame am for Arsenal’s first goal but e bin make some mad saves to deny them goals. I rate am 6.
Chris Smalling: E try today, e no do error. But i no know why e no bully Mustafi for that first goal. I rate am 6.
Eric Bailly: This guy be like military general for defence today. E no allow make Aubameyang play shingbai. I go rate am 8.
Marcos Rojo: Apart from hin goal wey lead to Arsenal’s second goal, e get good game. E also get hand for the equalizer. I rate am 7.
Diogo Dalot: E bin shine wella attackwise, but e struggle for defence, especially for first half. E bin show signs say e fit last for United, for many years. I rate am 7.
Ander Herrera: This guy ball fire for that midfield. E bin do one astray pass wey vex me sha. I rate am 7.
Nemanja Matic: Na him best United game this season. E impress me, compared to hin other rubbish games. I rate am 7.
Anthony Martial: E score and e sweet me. E no too cause trouble for the Arsenal defence. E woundjure, e pain me. i rate am 6.
Jesse Lingard: This guy try for attack and e also try for defence. E also score self. I rate am 7.
Marcus Rashford: Na one of hin best games for Man United this season. I rate am 7.5
Bench: I go rate Lukaku and Pogba 5, while i go rate Fellaini 3.