Manchester United boss Jose Mourinho don yarn ahead of the Premier League clash wey the Red Devils get against Liverpool on Sunday.
Everybody dey expect Mourinho’s men to lose this weekend but the Special One get important message for them.
Mourinho: “We bin get two good results against Liverpool last season. But Sunday own go dey different as old things don wash away. I dey focus ontop our next game, na the koko be that.”
Mourinho: “We dey play against team wey dey top form but we self sabi ball. The team wey i go play, go fight to win, no be draw.”
Mourinho: “For Valencia, people like De Gea and Matic bin dey available but i talk say make dem no travel. Apart from them, any other player wey no dey Valencia, dey injured.”
Advertisements