Juan Ikeji don release another edition of hin weekly blog and e talk about tori wey consign Manchester United:
We don continue our good run. We don win seven games straight and we hope say we fit continue am. The most important part of our season never happen yet and we gats continue like this if we wan achieve all our targets. Our moral dey high.
Our win against Brighton no smooth but i believe say we deserve am. Na our seventh win in a row. When you dey good form, you go dey win games wey you suppose draw. I wan hail Rashford for that hin special goal. The boy don improve true.
Our next game na against Arsenal for FA Cup. Their moral go dey high as dem knack Chelsea but we wan continue our cup run so we wan knack dem.
Advertisements