
Solskjaer: “Our aim na always the next game. So the koko na the game on Friday. After we play am, we go focus on the Burnley game.”
Ole: “As everybody go know, Wenger and Fergi na the managers wey last pass for this era. But Unai Emery na good manager so i dey reason say e go improve Arsenal.”
Ole: “My job now na to improve my team here. Na one game at a time, i no dey rush, i wan work with the players wey dey here.”
Ole don confirm say Alexis Sanchez go play against Arsenal but e talk say three Man United players go miss the game as dem don woundjure.

Ole: “Alexis go play. E go enjoy am if Arsenal fans dey boo am. Him na correct player so e go wan show dem pepper to silence them. The guy dey try for training, hin moral dey high, i hope say e go enjoy the game.”
Ole ontop Emiliano Sala: “Na sad news and everytime i dey wake up, i dey pray and hope for good news but the more time dey pass, hin chance of survival dey decrease. Na sad news for the family of the boy and everybody wey dey involved.”
Ole: “I dey reason say the club wan renew Martial and De Gea’s contracts, i no sabi the details, no be my job but i hope say we go get good news ontop am this week.”
Ole: “Shaw bin fall sick but e dey fine now. Smalling don resume training. Na only Rojo and Fellaini wey dey injured, so dem no go play.”