
Martial and Pogba wan kill Fulham
Manchester United don sneak through the back door, enter Top four as Arsenal and Chelsea dey fight each other. Na wetin happen after the Red Devils knack Fulham 3-0. Na Paul Pogba (2x) and Anthony Martial score for United.
The next game wey the Reds get na against PSG for Champions League on Tuesday night. But first, we wan talk about the five things wey we observe for this game:
The first thing wey we observe na say Manchester United defence dey solid today. I gats comment Luke Shaw, Chris Smalling, Phil Jones and Diogo Dalot as dem do no nonsense defending today. I like how dem take cover up for each other. Na why clean sheet happen.
Another thing wey we observe na say Paul Pogba and Anthony Martial bin run the show for Manchester United today. The assist from Martial to Pogba make brain but that finish from that tight angle na mad thing. Martial’s goal self dey bloody, e finish two Fulham players.
Another thing wey we observe na Ole Gunnar Solskjaer bin dey put half mind for PSG clash, na why e rest some of hin players like Marcus Rashford, Jesse Lingard and Victor Lindelof. PSG no go easy sha.
Another thing wey we observe na say Manchester United bin improve from their previous games. For second half, dem control game, unlike how dem do mumu against Leicester for second half. Na God save Fulham, e for end 5-0.
Lastly, United don restore the fear factor. Make we see if dem go survive the tough games wey dey come.