Manchester United caretaker manager Ole Gunnar Solskjaer don provide update ahead of the Champions League clash wey Red Devils get against PSG for Old Trafford on Tuesday night.
Ole: “We dey play against many top teams soon but we dey focus on the next one. We no dey look far because if you try am, you go lose focus. The game dey hungry us.”
Ole: “Sanchez and Martial fit play for many positions. No be fight, dem be teammates. The koko for us na to qualify for next round. E dey sweet me to coach them.”
Ole: “Since wey i don come here, Young don ball fire. Hin head dey work and e get experience. I dey happy for am.”
Ole ontop PSG: “Their team don improve wella over the years. Dem get some of the best players for this world. Dem get Buffon, Thiago Silva, Mbappe, Neymar, that only go tell you say dem don evolve and dem dey move up.”