Na the second real test wey Ole Gunnar Solskjaer go face after e fail the first one against PSG for Old Trafford. Right now, we wan see if hin team go bounce back after their first defeat under him as caretaker manager.
The next game wey Ole get after this one na the Premier League clash against Liverpool, so e go make sense if e win tonight so e go fit ginger hin moral ahead of that game.
Manchester United go dey without danger men Anthony Martial and Jesse Lingard as dem two bin woundjure for that PSG defeat so na big chance for Romelu Lukaku and Alexis Sanchez to silence their critics. Meanwhile, Chelsea bin recently chop 6-0 from Man City, dem go wan beat United go high their moral as that Malmo team wey dem beat 2-1 for Europa League na dead.
I know say this game go hard for United as the Reds don dey struggle for Stamford Bridge recently but i believe say Ole go lead hin team to a 2-1 win.