
James na the real deal
Manchester United don play their first pre-season game for Australia on Saturday against Perth. The match bin end 2-0 in favour of the Red Devils, the people wey score for the them na Marcus Rashford and James Garner.
We wan talk about the five things wey we observe for the game. Before we talk about am, hope say una don register for MUIP FPL o? As N500,000 dey up for grabs?? The deadline for registration na on August 16th.
Ehen, back to the game vs Perth. The first thing wey we observe na say Daniel James na the real deal but we go like sabi the wing wey Ole Gunnar Solskjaer wan deploy am from. For that Perth game, hin best period na when e dey left-wing. Na cause for concern as United get many players wey dey fight for that position like Martial and Sanchez.
Secondly, United bin press high up the pitch and dem recover balls fast fast. Na wetin impress me. The team wey dey use that kind style na Klopp as hin Liverpool team dey press very high up the pitch. If United fit do am next season, e go help them.

Chong never ripe
Thirdly, United na better team when Pogba dey play. Na him wey give the assist for Rashford goal self. Make dem no sell am, e go affect us bad as Andreas Pereira never ripe at all.
Another thing wey we observe na say Mason Greenwood don ripe for first team football and hin game dey remind me of Robin van Persie. As for Chong, him na right winger but e no ripe jare. Make e go play for our Reserve team jare.

Lastly, we like wetin we see for the game and we dey look forward to the next game.
Quality articles is the secret to be a focus
for the viewers to pay a visit the web page, that’s what this web
page is providing.