
We dey hear rumour wey dey fly around since say Ole Gunnar Solskjaer dey favour English players over non-English players.
The transfer window wey just close bin dey strange as na most people wey dey United Kindom, na him United dey sign. Also, all the players wey leave na non-English players.
If say Romelu Lukaku na English player, E for still dey at United, na the sad truth. Ander Herrera own pain us. But as dem don leave, we don accept am. The issue wey dey worry us na say United bin renew the contracts of Ashley Young, Phil Jones and Chris Smalling.
If say dem no be English players, United for don sell them since. The thing wey even pain most fans na the fact say Diogo Dalot no make bench vs Wolves but Ashley Young make am.
We hope say this rumour no be true sha, as e no make brain if our club na BRE-EXIT.