Manchester United don beat Jose Mourinho’s Tottenham side 2-1 for Old Trafford. The person wey score for United na Marcus Rashford (2x) while na Dele Alli score for Spurs.
Make we talk about the five things wey we observe:
Firstly, we gats praise Fred and Scott McTominay and their midfield duo make brain. In fact, na the best wey we don see of Fred in United jersey since e come. So we gats give am special hailing.
Secondly, Man Utd bin start the game really well. Spurs no start well, apart from their goal, dem no play shingbai for first half. If say United dey clinical, dem for win like 4-1 today.
Thirdly, Ole Gunnar Solskjaer bin get hin tactics spot on tonight. As hin Starting XI perform well, na hin make am win. Hin substitutions no make impact sha but nothing spoil, na 3 points be the koko.
Also, Marcus Rashford na United’s best attacker this season. No doubt
Finally, United still get plenty work to do if dem wan finish top four. Right now, no be the focus. The koko na to beat Man City next.